CALAMARI CROWDLOAN FOR KUSAMA

Jimoh Lukman Adeyemi(Jaylukmann)
4 min readDec 11, 2021

--

Calamari go be di nomba one Defi stack wey dey protect pipu informate wey dem build on top zkSNARK inside Kusama network.
INFORMATE ABOUT CALAMARI NETWORK
Calamari wey be di canary-net for Manta network na di plug-and play parachain(small blockchain under another big one) wey dey cover pipu informate wey dem do to dey helep projects under Kusama. Calamari join Kusama with zkSNARK together so that e go fit cover pipu informate when them dey buy,sell and replace one token with another .

Calamari network dey give pipu di following ogbonge things from their dormot
1)Maripay: Dis na di token-agnostic payment service (payment service wey dey work with different type of tokens from orisisrisi parachains under Kusama). Maripay dey cover informate of transfer on top kusama and him parachain assets plus including ogbonge crypto assets wey Kusama support.

Pipu fit use am buy and sell stable coin like Wrapped BTC and still enjoy di benefits wey come with make pipu informate no dey for public eye through ZKP.

2)Mariswap:Dis na di AMM DEX wey Calamari dey build. Mariswap go allow users turn one token to another and still protect their informate including their addresses. Mariswap go get him own liquidity pool(Where pipu fit put money to dey earn more money) yet dem go dey protected.

Na on top Calamari alone you fit dey protected so that pipu no go shook shook eye for your matter on top buying,selling and changing one token to another one. Know say Calamari dey work for all di parachains wey dey under Kusama.

INFORMATE ABOUT CALAMARI TOKEN($KMA)

KMA na di first token on top Kusama wey di total supply dey reduce automagically as pipu dey use am. KMA come with rebate, dash dash and token burn plus including protection for your privacy. Di first sharing of KMA go reach 10 billion tokens and the supply no go increase pass di nomba unless when KMA for crowdloan don finish.
Dis mean say if you hodl KMA, you go dey get free token with rebate and you fit withdraw wetin you earn on top Maripay and Mariswap. Remember say as you dey withdraw am, na so di supply go dey reduce because of di burn function wey dem build inside di token smart contract. Di token still get vote vote function and other ogbonge functions too.

SHARING OF KMA

KMA go be token for di community and di team mah no get their share for di token even private investor sef no dey. Dem plan to use fair launch share di token and di pipu wey be early bird for di token go enjoy for di distribution well well especially di pipu wey join their crowdloan.

DI PARACHAIN LOAN OFFERING AND HOW YOU FIT JOIN

Like 3 billion KMA go be for dash to pipu wey contribute KSM for Calamari-Manta on top Kusama auction. Di highest donation go be 300,000 KSM wey mean say after that any more KSM wey pipu no use go go inside di next parachain auction. In short, for all di ten Kusama auction, Calamari no fit raise pass di 300,000 KSM.

1)Di first stage na 1 billion KMA for pipu wey donate di 100,000 KSM for calamari. Di new stage go open if Calamari no win di auction slot but if calamari win any one of di stage ,di remaining KMA go go inside treasury for auction wey dey come for future.

2)Di highest for di second stage na 2 billion KMA for 200,000 KSM . If Calamari win,e go go di third stage.

3)For di third stage, na 3 billion KMA wego share give pipu, if di total contribution reach 300,000 KSM.
BONUS FOR PIPU WEY CONTRIBUTE
For every one KSM wey pipu contribute for di crowdloan give Calamari, di person go get free 10,000 KMA. Dis na for say make donors know say di amount of KMA dem go get no go different no matter di time wey dem contribute. Una go get more KMA as una take donate KSM. Una go get una KMA no matter how many KSM Calamari raise las las, dis na to make di distribution fair for every person. But sha, di first 1000 contributors go get extra 10% while di next 500 go get extra 5% KMA plus their normal 10,000 KMA per KSM.

BONUS FOR WHEN YOU BRING PIPU WEY CONTRIBUTE
Pipu wey contribute fit tell dem friends, family and work pipu say make dem come contribute give Calamari. If di person wey you bring contribute for Calamari, you and di person go get extra 2.5% join your normal reward wey you contribute.
OTHER INFORMATION

HOW LONG DI PARACHAIN SLOT DEY LAST

For make Calamari launch and dey successful, Calamari need enough KSMs to get one parachain slot. Dem go bid for 8 periods and each period go last for like 6 weeks (48 weeks)

LOCKING TIME

Calamari dey bid for di parachain slot through him crowdloan. All di KSMs go dey locked inside treasury for di 48 weeks wey I talk about for up from when dem win one slot till that 48 weeks end. If dem no come win any slot, di KSM wey pipu donate go dey unlock and dem go return all di KSM back to pipu wey donate am as dem get all their record.

VESTING ON TOP RESULT

After Calamari win one parachain slot, dem go release 34% of di total 10 billion KMA to their ogbonge community wey donate for di crowdloan. Di remaining 66% go enter their address every 8 weeks till dem complete di distribution.

For more informate,see https://mantanetwork.medium.com

--

--

Jimoh Lukman Adeyemi(Jaylukmann)
Jimoh Lukman Adeyemi(Jaylukmann)

Written by Jimoh Lukman Adeyemi(Jaylukmann)

A passionate web and block chain application developer, a technical writer, economic/business analyst, problem solver and team player.

No responses yet